Anonymous ID: fd7338 May 12, 2020, 8:02 a.m. No.9139684   ๐Ÿ—„๏ธ.is ๐Ÿ”—kun   >>9690

let's look to Nigeria for leadership instead

 

Wetin we know

  1. Lagos na di center of dis disease

Apart from say na Lagos bin experience di first case of di virus, di state currently get di highest number of cases for di whole kontri.

Wen di outbreak first start for Nigeria, na foreigners and pipo wit travel history mostly get am but now, community to community transmission don dey increase and Lagos no dey excluded.

  1. High population

Afta Kano state, Lagos get di second highest population for Nigeria wit small land mass.

Dis small land mass mean say majority of di over 21 million pipo for di state dey live closely togeda unlike oda states wey get more land mass.

Dis kain dense population go give goment tough time to enforce social distancing wey Sanwo-Olu don alredi hala say dey give dem wahala to manage.

  1. Govnor threaten anoda lockdown

As di cases dey worse dey go, Govnor Sanwo-Olu threaten say di state fit experience anoda lockdown if dem continue to disobey goment directives to control di spread of Covid-19.

Sanwo-Olu say di burden fall on Lagosians to behave like responsible pipo if dis virus go comot for di state.

  1. Di city fit battle with coronavirus till July or August

Upon evritin wey Lagos dey experience, di state neva even reach di peak of coronavirus outbreak.

Lagos state commissioner for Health, Akin Abayomi say dem dey suspect say di worse of di coronavirus palava fit happun for July or August 2020.

Di authorities say dem dey prepare for di long waka and dey increase dia capacities plus strategies to deal with di situation.

 

Wetin to expect

Despite all dis facts about coronavirus for Lagos state, e still no dey very clear weda or not authorities for di state go order anoda lockdown.

President Muhammadu Buhari wen im lift di lockdown from Lagos, Ogun and Abuja say state goments go need to make some decisions on dia own as e apply for dia states.

One tin wey dey certain be say, based on evritin wey di state govnor don tok since dem relax di lockdown, e no dey satisfied with how tins dey play since dem lift di lockdown. Govnor Sanwo-Olu don say e go need to make tough decisions if tins continue as e be.

Plus if di cases continue to dey rise and community transmission of infections continue to dey spread, goment go need to make dat decision fast.

 

https://www.bbc.com/pidgin/52604832

Anonymous ID: fd7338 May 12, 2020, 8:24 a.m. No.9139967   ๐Ÿ—„๏ธ.is ๐Ÿ”—kun

>>9139927

> I'm not going to sit here and play

oh man, i feel you.

it just exponentially amplifies the hypocrisy that the second they reject truth they expect you to play along with their liesโ€ฆ

>the smart ones, or supposed to be.

yeah, that's dangerous/not a blank check, as we can seeโ€ฆ

 

also what's irritating about this breed of wiser cattle is that the very things they will condemn you for, they consume as fiction in suspense novels & movies